e get one time i go write exam i don write exam, don write waec, e don reach about 6 times, d 7time way i wan go write exam na im i com dey pray am say God just make me pass dis exam, e com b say na english i dey look for, wen e com reach d day way we go write English, i don write economics, geography, mathematics write biology e com reach English, na so i com dey pray i say, God abeg make e b say d person way go siddon near me sabi English, e com b say i b candidate 29 dey look 4 candidate 30. O boi about 5min. b4 d exam, na im one girl just dey do catwalk dey com, we just hear koi, koi, koi, koi na im d girl com near my locker. wen d girl com near my locker na im she com look no.29 d nxt 1 na no.30, na im she tell me pls excuuse! me, d excuuuse me way d girl talk i say o boi-ye see english, na im i bend down 4 my locker say, God i thank you bcos i don pass. no do no do we dey write d exam anythg way d girl shed i go shed, if e clean i go clean after d exam nai im i say kai! if i submit d same time with dis girl dey go no say i copy after d girl go submit about 10min later na im me ma i submit na im i rush d girl go tell am thank you, i do si! si! si! d girl no gree turn, na im i rush go way she dey na im i tap am na im d girl turn look me tell me say what, what, wat! o boy na im fear enter my body na im i com dey stammer say Ii-i jos-jos just, I jos-jos just wan-wan to-to to to, na im d girl provoke as i dey stammer say, please! told me what you want to told me can't you see rain is caming i want to left please, na im i rush go back go collect my papper say, examiner i never finish abeg.
Posted: at 22-03-2012 04:44 PM (13 years ago) | Addicted Hero
jossy4reall at 22-03-2012 06:01 PM (13 years ago) (m)
ok......plz next
Love or Hate me its ur Biz, I have more important things to think abt since u never gonna change me
Posted: at 22-03-2012 06:01 PM (13 years ago) | Hero
master of mumu your prayer no go work, jossy don dey find another trainer 4 me.
hehehe see this mumu guy oo, yes i am your master because you are a mumu, no mumu can handle him self, so tonight you come to my palace and entertain my guests as you be my mumu after tonight i will sale you to a new master