GUYS: Advice No Be Curse

Date: 22-10-2013 4:35 pm (10 years ago) | Author: uduak Sophia Monday
- at 22-10-2013 04:35 PM (10 years ago)
(f)
Guys no be every woman wey una see for road be human being…some na mammy water, some na send dem send dem from coven .. no be evry woman wey fat get big nyansh and big Bosom  wey dey sweet for bed… if you no get pillow for your houx make u go buy ..no dey carry woman Bosom  dey do pillow…you sey u no fit follow slim girl waka for road sey na bone bone full her body… some of those egbewegers wey be like two bedroom flat today, na slim dem be yesterday…. Try to dey give your money for small small upkeep.. no be to dey phyuk phyuk her be the tin.. wen u buy generator atleast once in a while u suppose service the engine.. so that e no go knock engine.. the fine girl u see today wey dey shine for skin no be groundnut oil dey make am shine.. She dey rub beta creame wey dey smoothe her skin dey baf beta soap too no be key soap.. becos she demand for money for hair no mean sey u go begin complain anyhow dey bark like dog.. give her money for hair, and clothes .. so that wen anoda man see am outside en go dey appreciate they thank baba God for you.. no be wen another man come carry am u go begin to complain dey bark like dog… Marriage no be do or die affair.. no dey lie to woman sey u wan marry am wen u no sey shi shi u nor even get to take buy her lipstick or eye shadow..if you love her walk up to her, tell her the koko sey u be hustler.. even if u dey mould block telam sey na wetin u dey do.. she go happy sey u telam sey u nor get than to talk sey u get meanwhile u dey hop from one houx to another to find who u go squat with . make una leave orange/banana sellers alone.. if you wan buy market buy market pay her make she go.. no promise her sey u go buy all the orange or banana..den wen belle enter tomorrow u go begin run… make una do wetin dey right…no be to follow kukere way.. UNA GOOD-EVENING!!!



Posted: at 22-10-2013 04:35 PM (10 years ago) | Addicted Hero
- Jeninflower at 22-10-2013 04:54 PM (10 years ago)
(f)
Sister, walahi u try nor bi small, na true talk bi dat ,make our naija guys nor de talk lie for girls say their papa na dangote.wen dem see already made, their eye go de bling like say tomorrow nor de.na good advice u de give so, well done. Take all dis  Kiss Kiss Kiss Kiss Kiss Kiss Kiss Kiss
Posted: at 22-10-2013 04:54 PM (10 years ago) | Upcoming
Reply
- Shegzan at 22-10-2013 09:47 PM (10 years ago)
(m)
**lips sealed**

Posted: at 22-10-2013 09:47 PM (10 years ago) | Gistmaniac
Reply
- jossy4reall at 23-10-2013 06:36 AM (10 years ago)
(m)
wia una dey see dis mammy water and hw una dey take know dem,,abeg sophie link me up to one of dem,,,,me I want dem ooo

Posted: at 23-10-2013 06:36 AM (10 years ago) | Hero
Reply
- Dencybaby at 27-10-2013 12:17 PM (10 years ago)
(f)
lolssssss...i no fit shout
Posted: at 27-10-2013 12:17 PM (10 years ago) | Newbie
Reply
- Dencybaby at 27-10-2013 12:18 PM (10 years ago)
(f)
lolssssss...i no fit shout
Posted: at 27-10-2013 12:18 PM (10 years ago) | Newbie
Reply
- Dencybaby at 27-10-2013 12:18 PM (10 years ago)
(f)
lolssssss...i no fit shout.
Posted: at 27-10-2013 12:18 PM (10 years ago) | Newbie
Reply