e get one guy (federico) wey dey always come harrase sillyjoker for her beer parlour and the guy nah area father. every day him go come ask sillyjokker 'give me star OR..' sillojokker go fear carry star give am cos she no want trouble. the next day him go come again come shout 'give me gulder OR........' nah so she go fear carry the beer give am and d worst part be say him no go pay one naira. So one day sillyjokker come vex go call CID(teeco, omatseye, coolguys) make dem come stop dis guy from harrasing her. so dem dress 4 plain clothe come sidon 4 her shop the wait 4 this area kingpin make him come... e no tay federico come again come shout 'GIVE ME SMALL STOUT OR....' nah him teeco stand up show am gun say 'OR wetin?' nah him federico answer am 'OR PURE WATER EVEN THE ONE WEY NO COLD I GO MANAGE.....
just2sexy
To eat is Human, but to digest DIVINE!!
Posted: at 8-08-2009 01:15 PM (15 years ago) | Hero
coolguys235 at 9-08-2009 08:14 PM (15 years ago) (m)
just2lazy nothing do u i dey feel u jareeeeeeeeee...................... u didnt tell them that ur joke was ment for the newbies,,,,,as say udon graduate enter ....next level... well as the copyright detector i give u carry go.......... teeco.........wetin u say na.......... ......(mind u the newbie didnt know it was posted b4)
Geoin4matic Engineer ..
Posted: at 9-08-2009 08:14 PM (15 years ago) | Hero