state, im come write letter to im wife…..
My dear Sulia,
I no go fit send money dis month oo
because business no dey too move,
economy tight, infact global market crisis dey and don dey
affect my business performance so na 100 kisses I dey send
you. You be my sweetheart, my honey, my sweet potato
abeg manage and adjust.
Your loving husband Akpos
____________ _________ _________ _________ _________ _________
_________ _________ _________ _________ _________ ______
His wife come reply am …
My dear Akpos, papa lolo, honey mi. Thanks for di 100
kisses. Below you go see list of expenses wey I pay with di
Kisses…:
1. Obiora wey dey sell provision agree give us provision for
one week for 2 kisses.
2. Di NEPA man agree say im no go disconnect only after 7
kisses.
3. Oga landlord, Baba Tope dey come every day dey
collect 2 or 3 kisses instead of to dey take monthly rent.
4. Aboki Rabiu wey dey sell meat no dey take kisses so I
dey give am alternative pleasures, I hope say you
understand.
5. Miscellaneous expenses, 40 kisses.
Please no worry about me oo I still get balance of 35 kisses
and I go take am survive dis new month using this
balance…
Shall I plan the same for the next month..

Your Sweetie.pie
Sulia
Posted: at | |