@divineproject did u read wat i wrote or u jst dey tlk ur own? when them say maga, na who b d maga? na u b d maga, na me b d maga, all of una na maga, everybody na maga, traders, doctors, pilots and bankers, our government jst dey take us for a ride, from paris to london na everyday them dey fly with all our money while d masses jst dey cry, d worst tin b say for their mind dem dey try! banky nor see those ones? na so him wan take contribute to d music industry? inshort how much them pay am to waste dat him gathered time? shai see as my people jst dey die, shai i nor fit bear d pain my guy i need to high, dis is unfair walahi talahi, bt think abt d matter he dey b lik make i cry..na lack of employment make them yahoo bois dey press laptop nonstop cos they wan chop,hustle everyday yet maga nor dey still drop as he bad reach bois don dey do yahoo plus (juju/ritual) d true is the truth, the bad is the bad, maga nor need pay YES but not yet, no food no job so bois gat to bomb jst to chop.
Still on the matter, na who b d maga? d masses dey hala, gorvernment na bagger, embezzle d money and d masses jst dey para, receive some kparaga and stagger lik mad man.
If maga nor need pay musicians go turn gay, i cant party every night, even on my birthday cos i go dey fear robbers every night and every day. monday to sunday, friday to saturday every body here na click click where d money dey, pass us d naira, take ur life, rape ur wife, stab ur kid with a knife, some MC dey ves with d stress and chanlengings, people dey die for jos him dey sing about cyber crime, how much them pay am jst to waste dat him gathered time?
Banky na maga, d rest of them na fool and all of their father, d situation in the country is rough and tough, CYBER CRIME BOI na ur father get microsoft? NO! jst bcos u got pay probably u got lay dats why ur screemin at the top of ur voice..small bois i nor go call ur name for here, them use u complete bass u come dey fill like super star.
Ok Ladies a gentlemen as the story goes u knw u want me to dis my pple and get two hundred dollar, NO! i ain't doing dat, i represent my country mennnn i ain't selling @, u do sth abt d situation of the country and i will giv u five hundred pounds u know? yeah dats wat its is i love my country i love my poeple, 9JA for LIFe MEn...am signing @@@@.
They closed the door but that ain't stop me from coming in
;)
Posted: at 20-05-2010 05:12 PM (13 years ago) | Gistmaniac |
|