Even the almost one thrillion Naira for security sef, we don close our eyes bros,if you like , no do any road again,we no go ask you,
Fuel scarcity --?

This one wey nigerians life no come even get value reach cockroach for oyinbo land own tire me ooh. bros , just use all your head and mind dey see how you go take dey protect us, we no need all those things wey we dey disturb you for,na long throat dey do us,just help us make we day sage bros,if you fit do that for us ehn -- i go join curse anybody wey ask you how you dey take spend we money,we no wan to dey waka dey fear say na next sound fit be the bomb sound bros,
We no wan to see fellow struggling nigerians dey roast like chickens wey oyinbo say them get bird flu,bros J, sebi you talk say you no get shoe?
E means say you too be one of us before before.if dem former leaders no protect you allow bomb finish you.sey you for reach where you are so tey you no fit no how many shoes you get,
GOD wey carry you reach there never resign ooh. and na HIM i dey take beg you make you do every thing to see say we too live oo, i beg bros J , no mind all those people wey say you no go continue,
Just protect our lives for us,na your hand soldiers , police all of den dey,use dem protects we poor masses na,no be only bigg big men and women deserves to live safe,we too na life dey our body,and wetin fit make wey una dey where una dey so,we too fit reach there ooh, one ooh, but that one na only if we live ooh,
i take GOD beg you bros J,na beg i dey beg no be strong head oooh,
greet mama peace, abi wetin dem dey call her for me
Posted: at | |