EAGLESEYEZ your hairstyle always dey remind me of sahara desert.
see your face like last two years
Studio Thx for joining, you suppose put pishure make dem no start think say na EFCC u dey fear
With your tear tear shirt like ashewo pillow case.
With your scatter scatter teeth like roasted corn when them take set rabbit trap.
With your scatter scatter teeth like Mafoluku Railway
You say you be pastor, you wan lead prayer you say "Everybody close your head and bow your eyes
Teacher say make u name country outside Africa, U say "Abroad". Teesha that no be country, try again, U say "Away"
I hear say na garri water and egusi soup dem dey put for your junior broda feeding bottro (bottle)
You wowo sotey, mosquito bite you catch malaria
you waw waw sotay admin no gree make u add pishure
Make a sentence with pink, green & yellow: As I was at home, the phone ring "green", I "pinked" it up & said "yellow" can i help you.
dis your pishure wey resemble mamiwata so.
wit your fake picture like 419 passport
Because of groundnut you follow rat enter hole.
I mess, my own sound "kpro", you you mess your own start to sound "papakipa, papakipa buguru tuo tuo!
you mess, 3 pawpaw burst
Posted: at | |