Na so two of dem go market one day go buy things to take cook food.Dem buy life chicken,turkey pepper,tomato,rice,....all medemede sha wey dem go take cook.
When dem don almost reach house, na im the pikin remember say im never buy curry, thyme and onion.E come give im papa the house keys say make im carry the other things go house so that im go buy the things wey dem forget to buy.
Small time reach the chicken comot form Papa hand begin dey run, dey go.People come see papa start to dey laff na im dem ask am say why im dey laff chicken dey go?.....e say,silly chicken,im think say im go reach house enter before me when na me hold the key to the house........
Posted: at | |