E get this particular restaurant wey I dey chop for VI, e get one oyinbo wey dey always come chop there too. Any time dis oyinbo chop finish he go shout "HEY", so I wonder wetin dey make am shout, I decide to chop wetin the oyinbo dey always chop so maybe me self go shout too. When I reach the restaurant last week friday, I order wetin the man dey chop. Dem tell me say na chicken and red wine, so I chop am, but I no shout, I collect extra plate, but still I no still shout. Na then I just vex ask for my bill. The waiter tell me say one plate of chicken & red wine na N45,000 then the extra plate na another N45,000 so all together na N90,000. na then I shout heyyyyyyyyy! ? ?heyyyyyyyyyyy!! heyyyyyyyyyyyy!!! Heyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyy!!!:/:O:'( =))
Posted: at 10-09-2011 04:58 PM (13 years ago) | Gistmaniac
mixbrown at 10-09-2011 05:02 PM (13 years ago) (f)
Heyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyy
Posted: at 10-09-2011 05:02 PM (13 years ago) | Upcoming