In WAEC examination, Akpos was asked to complete the following: . (1) He who fights and run away? Akpos: E don surrender be dat na, na fear catch am. (2) A rolling stone? Akpos: No fit just dey roll, na person push am. (3) He who lives in a glass house? Akpos: Na rich politician e go be. (4) A stitch in time? Akpos: Dey prevent further tear tear. (5) Birds of d same feather? Akpos: Na d same mama born them. (6) One good turn? Akpos: Na correct power steering fit do am. (7) A bird in hand? Akpos: Wetin e wan be again if no be barbeque. Dem plenty for chicken republic. ( Half bread is better than? Akpos: Puff puff, buns or garri without sugar. (9) A journey of a thousand miles? Akpos: Na d person wahala be dat na, Why e no enter car or aeroplane jeje? (10) He who laughs last? Akpos: Get brain problem. Make dem examineam becos na beginning of madness be dat. (11) A patient dog? Akpos: Na hunger go kill am. (12) All work and no play? Akpos: Na bank job be dat bros. (13) Once beaten? Akpos: Na revenge go follow b dat. (14) A fool at forty? Akpos: U never see Naija own, ours starts @ 50. (15) A friend in need? Akpos: Na parasite b dat. Will Akpos pass the exam ??
Posted: at 28-07-2012 08:39 PM (12 years ago) | Gistmaniac
chummyli at 28-07-2012 08:44 PM (12 years ago) (f)
Dis joke don old wit grey hairs... I pass u d mantle of pb4 club presido
Chummyli d Great... May ur days be elongated for Naijapalling...
Posted: at 28-07-2012 08:44 PM (12 years ago) | Hero