Did he tell her abaut the payment arrangement when he was inviting her or just told her to pay for herself on the venue ?
she was very surprise when d guy brought out huge of money
and paid for his ticket and then asked her to pay for her own and
also get a drink for herself as well
You friend kept her mouth shut? Is she a fool? She no insult d guy? She no tell d guy make e go drop her for house? She no vex call her own cab? Ehn? Which kind of disrespect is that?
Say the guy carry bundle of one thousand naira notes, d form on top movie? and Pop Corn and fanta? Blessedme, na which kind of friends you get sef?
You no know say, dat money dem go drink hennesy and black label and all those bad bad bad shaio from inside when e hook up with im boys in dey evening? If na d first time, tell ur friend make e no ever call this guy again. In fact d guy is a stingy immoralforker. Abi your friend na gold digger? Your friend na ashawo? Ehn?
See, any guy wey d dey stingy for paroles wey you with am d catch, dat guy get problem. If say dem waka go there differently, then e dey different.
=========
D guy harsh sha. E good for plenty naija girls. Especially Abuja girls. Just yesterday, dem d jist of me one girl wey return 700,000 to her boyfriend and d halla ontop again. She d halla say wetin d guy want make she use the change do? Say na one point something she demand for. Chai! World don spoil. She won buy bridge for abuja? She no know say that money go train 5 children from five families for my village go Nigerian university. Ha ah hahahahahah.
D guy harsh. correct guy. Ha ha hah a hahah. I wonna be like him when I grow up.
Some guys do know how to give you girls reality. Ha ha hahahahah.
Chai!!!!!!!!
I swear, I won get this kind of liver. This na extreme liver. I hope that your friend fine well wel. Because this kind stinginess no good for normal girl. E good for those ones wey no d know say other humans dey exist. Ha ha ha hahahahahah.
Good story. Good story. Afterall it is not as if if she doesn't see the movie she will die. It is not as if if she doesnt drink fanta and chop pop corn she go kpeme. Ha a haha hahahah. Wow!
-----------------
That guy is good. I am sure your friend is already in love by now. Abeg forward me the guy address. I need some lessons on how to the pull the emotional strings of chickalas them fragile hearts. Ha ha hahahahahha.
Posted: at 18-10-2010 02:48 PM (14 years ago) | Upcoming |
|