Two young boys in my area were fighting ferociously. While one was hitting the other hard saying "na today u go die, u think sey u smart ehhn". the other one was shouting "na me catch d fish na" repeatedly. I showed up, seperating them i asked "why una dey fight?" D older one answered "me and tega catch fish and we say who catch go give am to the other pesin, na so we dey do am everday, everyday na me dey catch and i dey give am, 2day wen he catch, he no wan give me carry go house, instead he say make we lie and sey pesin wen go lie pass, na im go get d fish". soooo??? i asked. he continued "na im i tell am sey na me kill my papa, him sey na small lie" "Wat now happened" i asked inquisitively. the boy answered, "tega kon sey na im give my younger sister belle, na im we start fight". who con get d fish? i asked. "Nobody" they answered. So as a sharpman, i now said "see wen i dey una age eehn, i no dey lie at all, na bad thing, even till now sef i neva lie". ma im one of them shout "Akpos i don die oh! shebi i for carry dis fish go house and we for share am? see now"
Na im both of the look me say "Bros take, na u win, na u get d fish"
Posted: at 31-10-2008 06:09 PM (16 years ago) | Gistmaniac
rezimero at 31-10-2008 06:23 PM (16 years ago) (m)
BROOOOOOOOOOOOOOOOOOOOOOOOOOOOOOOOOOS!!!
Posted: at 31-10-2008 06:23 PM (16 years ago) | Gistmaniac